Dem say see danger oh You no dey see danger oh No go lose your center oh All because of paper oh Dem say see danger oh You no dey see danger No go lose your center oh All because of paper oh Yeah Check All because you want to live the faaji life You ready to pay the price Do the sacrifice You ready to pay the price Take your mama life And even you no fit explain this your appetite You want the benz You no wan take the taxify You wan order gold bottles Maybe 35 You wan halla "private jet things" When you catch flight Now you don dey shey weyrey lonso You don dey bark for night Skeleton is in your closet You murder to chow suppper All the wraps of powder You swallow to pass border All the person pikin you carry for tight corner I see you when you collect Ekun je Oga olokpa Dem say you talk say you dey find raba Na say you go and dip your two hands in foul matter Oga this one you dey do E pass arm robber You turn criminal Because you want to chow dollar Dem say see danger oh You no dey see danger oh No go lose your center oh All because of paper oh Dem say see danger oh You no dey see danger No go lose your center oh All because of paper oh Yeah Check Ah All because they offer you a little dollar Na which kind foolish marriage wey you throw your daughter Small girl pikin wey her hero still be Dora Small pikin dem wey never suppose leave the mother You need to hammer You need to get the dough E dey important You want to chop national cake You dey pray for contract Dem give you Ghana must go Make you change the number Voting never start You don dey say your congrats Why your people no fit hide this long throat No go use your dirty hand stain the white for my cloth Mouth full of jokes Hand full of notes Oh I hear your people collect rice for some votes Dem say you talk say you no like suffer Na so you go and deep your two hands in our coffers Oga this one you dey do e pass arm robber Throway moral Because you want to chow dollar Dem say see danger oh You no dey see danger oh No go lose your center oh All becasue of paper oh Dem say see danger oh You no dey see danger No go lose your center oh All because of paper oh